Tiff Gang Don Cut Police ASP Head Komot For Aba

Some bad tiff guys wey go kill the ASP of police for Abia State along East Street Ndiegoro for the state don dey threaten the whole pipo wey dey there.

The ole pipo kill the ASP wey come from Ebonyi State and pipo know am as Agbalagba then kill am finish come cut hin head on Tuesday morning around 5:00 then karey he uniform and gun.

As Dem dey investigate the mata, nai one police source say with information wey dem don gather na those bad tiff gang wey police kill dem leader on Sunday April 23, 2023.

The leader of the gang JT, that Sunday get am hot with police as dem catch am wey hin dey tiff naso the fight with gun take start.

The Police man come tok say JT and hin gang start to shoot immediately dem see the police, naso police sef start to pursue dem enta Orji Uzor-Kalu bridge wey join Ngwa Road, Pepples road and Akpu road.

As JT see say the police nor wan gree, nai he jump enta Aba River make he fit run enta the Ovom/Azumini side of the river before the police come shoot am inside the river.

As pipo for the area hear say JT don die naso dem start to celebrate, but on Tuesday, May 2nd for East Street nai the gang go kill the police Superintendent, naso fear start again.

One pesin for the area wey tok but nor call hin name say all the pipo wey dey stay for East Street, Ngwa Road, Akpu Road, Ndoki Street, Etche Road, and Ulasi Road wey dey for Ndiegoro don dey shake as the tiff gang say dem and police go get am wotowoto for dem hand.

One police officer wey don even retire tell the New Telegraph say dem even threaten to burn police office and attack dem, with that kind threaten hin say e don reach for the Inspector General of Police, the Commissioner of police and other security ogas to come look wetin dey sup for Ndiegoro, especially the one of Ogbor-Hill.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM