Tinubu Don Travel Obodo Oyibo To Meet Investors

President-elect Bola Tinubu don travel to obodo Europe for working visa.

Na from Murtala Muhammed International Airport nai Tinubu take fly on Wednesday afternoon.

The media aide of Tinubu, Tunde Rahman, say hin go use the opportunity of the trip take plan the way hin govimet go work with some of he key aides, wey nor go cause pressure.

Tinubu go still do meeting with plenty investors wey dey for Europe.

The media aide say the president-elect don promise to start work sharply and this visit join for hin promise so that him for tok with pesins wey go epp for the economy and security of the kontri.

“Before he komot from the kontri, Asiwaju Tinubu meet the House of Representatives candidates wey APC  want make dem be Speaker and Deputy Speaker, Hon. Tajudeen Abbas and Hon. Benjamin Kalu, wey the Joint Task Team of the House karey come show am.

Rahman say Tinubu go come back to the kontri before dem go swear am as the 16 president of Nigeria for May 29.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM