+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu Nor Tok Bala Blu – Campaign Director, Dele Alake

 

 

One chieftain of APC Dele Alake say that go video wey fly for November last year wey the presidential candidate of APC, Bola Ahmed Tinubu dey say bala blu…bulaba na fake.

Alake nai be the Director of Strategy and Communication for APC Presidential Campaign Council say na pipo wan just spoil their man.

Wey Alake dey tok for interview with Nigeria Info FM nai hin take say that tok of Bala Blu, na just media pipo bring am to spoil Tinubu.

Hin say “Nor be true, na fake. We show the real video for TVC  and na pipo for outside come cut and join am to make am funny.”

The foma Commissioner for information say na Tinubu be the man and February 25 everybodi go see am.

For August last year nai Alake take say Labour Party presidential candidate Peter Obi and hin supporters na waka pass for Nigeria film.

Hin say wetin Tinubu don do pass Obi own and dem two nor dey the same level.

 

 

Share On:

1 Comment

  • Onome

    Is it by levels? It’s by what each candidate has to offer and with d manifesto presented by each candidate, I think Obi is the best bet.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM