Tinubu, President-Elect Go Land Nigeria today

As May 29 dey around the kona wey Nigeria go take put the new president, Bola Tinubu wey go sitdon for the most powerful seat for the kontri, he go enta Nigeria today.

Na Bayo Onanuga, Director for Media and Publicity, nai tok so on Monday.

For Twitter nai Onanuga say the president elect don dey for France since dey rest afta the election.

Remember say na March 21 nai Tinubu, the president elect take off and hin campaign council say he wan go rest and dey ready for May 29.

The statement wey the APC presidential campaign council bring out for March tok am say na France Tinubu go rest afta the stress wey dey for campaign and election.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM