+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu want Make Court Give Am Order To Check Election Materials

 

President-elect, Bola Tinubu don go meet court of Appeal for Abuja on Tuesday make dem tell INEC to allow am check the result wey hin take win the election.

Na Mr Akintola Makinde the lawyer to Tinubu nai say he need to go look and make photocopies of some of the election materials so that hin fit use am prepare for the case wey dem dey bring against Tinubu.

Makinde say: “The materials go epp us to prepare and defend awasef then even use am take compare with the one wey INEC get for dem back end server.”

Tinubu don bin file case for March 6, put Labour Party and dem presidential candidate, Mr Peter Obi plus Peoples Democratic Party, PDP, and e candidate, Atiku Abubakar, join with INEC as pipo wey go ansa for the case.

But the court wey wan sitdon for the Presidential Election Petitions Tribunal, karey the application of Tinubu go Wednesday.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM