Today Abia Go Hear Who Be The Winner Of The Govinorship Election

 

INEC go use today Wednesday take announce who be the winner of the Abia state govinorship election.

INEC Head of Voter Education and Publicity, Mrs. Rebecca Jim nai tell ChannelsTV on Wednesday say as dem suspend the calculation of the Abia result, dem go start again by 4:00’clock today for Umuahia Collation Centre.

Mrs Jim say the Presiding Officer and Vice Chancellor of the Federal University of Technology Owerri, FUTO, Professor Nnenna Oti; and the State Administrative Seketary, Clement Oha, wey INEC call come dem headkwats for Abuja cus of the many wahala wey dey happen for Obingwa results, but now dem don dey go back to Abia state to complete the calculation of the results.

INEC National Commissioner, Festus Okoye, say the resin why the Commission suspend the calculation of Obingwa LGA result, na cus jaguda boys bust hin office on Sunday.

Even for Nkanu East and Nsukka LGA for Enugu State dem still suspend the result so that INEC go look am well.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM