Tukur Mamu Wey Dey Tok With Terrorist, FG Don Karey Am Go Court

 

Tukur Mamu the foma terrorist negotiator say him nor do the 10-count charge wey FG put for hin head unto koleting monie from terrorism financing join with oda tins.

On Tuesday nai Attorney General of the Fediration karey Mamu go meet Justice Inyang Ekwo wey dey Fediral High Court for Abuja.

Na for September 6, 2022, nai dem take catch Mamu as he dey go Saudi Arabia for Lesser Hajj, say hin epp Boko Haram terrorist kolet 120,000.00 dollar ransom payment from the families of those pipo wey dem catch for the Abuja/Kaduna train attack.

Attorney general bin don first say Mamu for 2022 epp Boko Haram kolet N500,000 for Kaduna from the Abuja/Kaduna train attack pipo families.

FG still say hin dey use voice messages take dey tok to one Boko Haram tokpesin wey be Baba Adamu.

Dem come still say FG see 300,000 dollars with Mamu wey dem catch am.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM