Minister of Aviation, Hadi Abubakar Sirika say make pipo nor fear as dem don open Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja afta tyre bust for the road wey plan dey pass on Sunday.
The Minister say dem don karey the plane wey the tyre bust, clean the road and ready am again for movement.
On Sunday nai Max Air plane tyre bust as e dey fly from Yola dey come Abuja. The 144 pipo wey dey inside the plane dem come out without any scratch.
Mr. Allen Onyema, the Vice President of Airline Operators of Nigeria, AON, that is pipo wey get airoplane nai come bring statement wey make pipo mind come down as he say na one of the tins wey dem dey see for the business.
He say make pipo nor fear to fly cus of the tyre wey bust and Max Air nai be one of the plane wey dey safe for the whole world and make pipo nor use cus of the tyre bust take dey laugh dem.
The statement come still say na NCAA dey watch airplane for Nigeria and dem nor want make any airline get problem. Dem say this bust wey the tyre bust nor go stop Max Air to dey still dey do Dem beta way of flying.
But before the plane fit komot from the runway, pipo wey wan fly get to wait for Abuja.