Uganda Ghetto Kids Do Wonders For Britain Got Talent

No be small happiness nai happen just now for the Britain Got Talent 2023 wey just start for UK, ma there this children dance group from Africa ‘The Ghetto Kids from Uganda’ take shocktalize everybodi , come even get the almighty Golden Buzzer ontop.

The Ghetto Kids na 30 children wey dey stay togeda for one orphanage for Uganda.

The Ghetto Kids just make every bodi open mouth finish dey wait for dem next step even judges like Simon Cowell,  Amanda Holden, Alesha Dixon, and the newcomer Bruno Tonioli wey shock pass with the way the children dance.

Bruno Tonioli wey be from Italy and dey teach pipo dance, as the children dey dance the man nor fit hold bodi one place.

Naso the man jump go press the golden buzzer wey dem nor dey quick press, as he press am sef, The Ghetto Kids still dey dance ontop.

Tonioli tok say the way the children dey dance, make am be like say bomb dey hin bodi wey wan explode.

“My bodi just dey do me jiriri wey una dey dance  Una suppose dey branama, I nor fit wait to see una again.”

“I just get to do am naw,” Tonioli say nai be the resin why hin open the buzzer and that wan mean say the children dance group don make am for the talent hunt.

Even as the Golden Buzzer drop for dem bodi The Ghetto kids still kwatinue to dey dance ontop the golden shinny shinny.

 

Share On:

1 Comment

  • Wise Chris

    What God can’t do doesn’t exist take it or live it (honestly) what I understand is when d appointed time has come for you to shine delay is inevitable

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM