UK Court Send Ekweremadu To 10 Years For Prison

E don bust as UK court don send Ike Ekweremadu, hin wife Beatrice and dokitor Obinna Obeta, Nigeria dokitor wey dey work for UK go prison cus of the kidney transfer case wey dey ground since last year.

The court give Ekweremadu ten years to serve for prison while dem give he wife six years term.

Na for March nai the Old Bailey say the husband and wife plus Dr Obeta wey stand as middleman dey guilty of the charges.

While Sonia Ekweremadu daughta wey dey sick serious kidney sicknes just dey cry every where full as dem nor call her name join.

On Friday wey the court dey sentence Ekweremadu, dem give am nine years and eight months to stay for prison, while hin wife Beatrice get four years and six months sentence then dokitor Obeta dem use ten years take dash am for prison.

The judge of the case, Justice Johnson tell dem say wetin dem do too serious for dem to pay fine or do community service nai make he send dem to prison.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM