Una Wey Wan Tiff Motor From Govimet My Eye Dey For Ground – Darius Ishaku

Govinor Darius Dickson Ishaku for Taraba State don dey warn all pesin wey dey work with govimet make dem nor run with govimet motor or property.

Na through circular wey the govinor send to Ministries, Departments and Agencies, MDAs, on Thursday for Jalingo, nai hin take tok am say any bodi wey dem see with govimet property nor go waka free.

Report get am say some too govimet pipo don already dey plan to kawa with govimet property as dem party gift afta service for office.

Ishaku come say make dem nor borda as he don already know dem hidden plan and he go make sure say all those govimet workers wey get ojukokoro eye nor see any tin wey dem go gbaskele go dem house.

The circular so come from the govinor through him  office of  Seketary to State Govimet (SSG), then Permanent Seke, General Services, Ibrahim Dan’Azumi sign ontop too.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM