Update On 2023 Census Go Happen

National Population Commission don say how dem go take do the 2023 census.

The Commission say dem don plan to start to number building and houses from April 17, before the real census go start for May.

Dem say the five days wey dem wan use take train pipo wey go follow dem work na from April 25 to 30, 2023.

With wetin NAN report, the Kwara state Director of NPC, Alhaji Sa’eed Yusuf nai tok am on Wednesday for Ilorin.

Yusuf say na the whole kontri dem go start the building and house numbering.

He still say the training of pipo wey go work with dem for this year Census no go be March 31, as dem  first put am cus of one or two tins.

Yusuf say dem go start the training from April 25 and 30 for the different LGA.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM