The Central Bank of Nigeria don tok dem own say the old N200, N500 and N1000 notes, pipo go use am till December 31, 2023 the date wey court give.
On Monday nai Isa Abdulmumin, the tokpesin of CBN announce dem decision.
The statement tok say: “To folow wetin court order and rule of law, Presido Muhammadu Buhari govimet and CBN dey tell all banks make dem folow the judgement wey Supreme Court give for March 3, 2023 say make dem use old and new monie togeda.
So CBN don tok with Bankers Committee and dem don ready to dey kolet the old N200, N500 and N1000 notes untill December 31, 2023.