The National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) say the video wey dey trend with some pipo wey wear red jacket wey be like dem own for inside one small bus as dem dey smoke higbo, say na old skit wey NDLEA don even come out last year to say nor be dem.
Na Tokpesin, Femi Babafemi of the agency nai tok so for Abuja on Tuesday.
Babafemi tok say : “The agency for Saturday 21st May 2022 bring statement about the video with pictures from the video, wey dem come check to know say na skit wey one Matthew C Eze for Lekki do.
“Afta one year the video don come out again for social media, wey make pipo come dey ask weda the video na real.
“We want still let every bodi know again say the confusion wey dey for pipo mind about the video nor be true and make social media pipo wey dey do video online know how dem dey do video about law enforcement agency, so that pipo nor go dey confuse.
“The agency still wan let those wey dey use dem uniform anyhow to confuse pipo, say dem go dance to the music.”