Dem don see one new born baby girl wey dem troway for dustbin inside Port Harcourt, Rivers state.
No bodi know who go troway the pikin wey the placenta still dey with the baby for early mormor nai vigilante group wey Godstime Ihunwo, Chief Security Officer for Nkpolu Oroworukwo Community, Mile 3, Diobu lead on Friday take see the baby.
Ihumwo say na around 3:00 on Friday morning wey dem dey patrol nai him take see the new born baby, and e never pass 6 hours wey dem just born the pikin. Dem wrap the baby for clothes join with him placenta.
“I just rush karey the pikin, then call one woman nurse , as she come nai she look the baby come know say na girl.
“I call Prince Wiro, one Human Rights Activist, wey sharply come my office to follow me go Nkpolu Police Station wey I take go tell dem wetin I see.
“I dey beg Rivers State Govimet make dem tell the contractors wey dey incharge of Ikwerre Road street lights to always dey on the light for nite. We don see say some nite dem dey off the light.”
Prince Wiro wey be journalist and Coordinator for Centre for Basic Rights Protection and Accountability Campaign, wey folow save the baby come dey beg young pipo wey born pikin wey dem nor want to go meet govimet agencies or civil society groups instead of to dey troway the babies.