The Independent National Electoral Commission (INEC) don carry the deadline to collect permanent voters card(PVC) go January 29.
INEC announce this one for one statement wen Festus Okoye wen be the national commissioner and chairman for information and voter education sign.
INEC bin fix December 12 to January 22 say make people take collect PVC for all the 774 LGAs for Naija.
Dem bin also talk say dem go carry PVC collection go the 8,809 registration areas/ward from January 6 go jam January 15, 2023. After this date, those wen never collect go collect for their local government office till the deadline reach.
According to wetin INEC talk, as dem don carry the deadline go front, people go fit collect PVC for their registration area/ward from now until January 22,then from January 23 na local government office them go take collect.
According to the statement “For the regular meeting wen happen today Thursday 12th January, the commission talk about many tins even the collection of voters card wen dey go on now.
“The Fact say plenty people come out to collect PVC for naija dey encouraging to INEC. For some states, like 100,000 PVCs nai dem don collect in the last five days since dem carry am go Ward level on Saturday 6th January 2023.
“INEC mind na to make sure say registered voters get enough chance to collect their PVC before the election. Na this one make INEC carry the deadline go front with eight days.
“Instead make E end on Sunday 22nd January 2023, PVC collection go dey on till Sunday 29th January 2023. For now, na 9.00am – 3.00pm everyday (Saturday and Sunday join).
“So because say we extend the date,we also adjust the way e go go based on location: To collect for registration area (Ward) level don go front by one week from Monday 16th – Sunday 22nd January 2023:to collect for local government office go start again on Monday 23rd – Sunday 29th January 2023.”