All the katakata and wahala wey dey happen ontop this new naira and how to change am go end as supreme court go decide the mata today.
The seven-member panel wey Justice Inyang Okoro dey lead, say no bodi go join the case again.
Hin tok say any new pesin wey wan join the case, make e just relax and folow the case or wait make dem judge this case finish then bring up new one, but for this case na today e go finish.
Justice Amina Augie say you fit bring new case afta this case don finish.
The resin na cus the Attorney General of Abia State bring case come say dem wan join the case from anoda side wey don already be like the one wey Rivers State Govimet bring come through dem counsel Emmanuel Ukala, SAN.
The panel, therefore, was consolidated by the Rivers State Government alongside other suits.
Afta dem announce the 11 states wey join for the case plus Kaduna, Kogi and Zamfara, nai the panel start to dey judge the mata.
But Bayelsa and Edo dey for the side with other states wey dey support Fediral Govimet.