+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Do Count Pipo For Sambisa Forest – NPC

 

Nasir Kwarra the Chairman of National Population Commission (NPC), don tok am before say insecurity nor go stop 2023 census as deme go count pipo wey dey stay for Sambisa.

He say the house dem wey dey for sambisa dem don map am well to know the boundary nai be the process wey dem call Enumeration Area Demarcation (EAD), with that dem fit do census for everywhere for the kontri.

Kwarra tok so for presentation wey dem do yesterday for Abuja to check oga Buhari score card.

Hin say the mapping wey dem do don make the commission get digital data of all the house wey dey Nigeria, and e epp dem well for the census.

Wey dem ask Kwarra how much dem don spend, hin say the monie pass N100bn and dem don use am take dey prepare for the census.

On his part, the Minister of Information and Culture, Lai Mohammed, come say the census go really epp the kontri as dem don put enough technology for the excercise.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM