+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Punish Any Bank Or Pesin Wey Nor Kolet Old Naira Ebonyi Govt

 

The way the case of the old monie and new monie dey drag who go stay for market e don karey play enta every where as pipo nor dey gree kolet am even afta bank don say na December 31,2023 e go take end.

Cause of that the Ebonyi State govimet on Wednesday say dem must give wotowoto to any bodi wey nor gree kolet the old naira notes.

This one dey for statement wey the Commissioner for Ministry of Finance and Economic Development, Orlando Okechukwu Nweze issue say anybodi wey nor wan kolet the old monie dey go against law.

Part of the statement na: “Make everybodi know say CBN don karey the use of old N200, N500, N1000 untill Dec 31st 2023.

“Anybodi wey nor gree kolet the old N200, N500, and N1000 dey go against the law and the state govimet go punish am with wetin the law tok.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM