Charles Oputa aka Charly Boy wey dey sing don tok about the tori wey dey fly about Seyi, the son of President-elect Bola Tinubu wey go buy property of over $10.8 million for London, United Kingdom.
One Bloomberg nai report say Seyi buy one $10.8 million property for London wey EFCC seize from foma petroleum minister, Diezani Alison-Madueke loyalist Kola Aluko, for 2017 through Aranda Overseas Corp wey be an offshore company and him na get the main share for the company.
So as Charly Boy dey tok hin own side of the mata for hin Twitter handle on Wednesday, he say this na just the starting of wetin Nigeria go sew if dem swear Tinubu the president elect put for position on May 29th.
He say make Nigeria ready afta dem don swear in Tinubu.
For that hin Twitter Charly Boy come put screenshots of the mata wey dem nack ontop Seyi Tinubu head, come write say, “We never see anytin.
“If the president wey INEC select finally enta for May 29th, we go see Shege Banza.”
(Daily Post)