We Go Stop Fight For 3 Days —Sudan RSF Military

Rapid Support Force (RSF) wey be para military group for Sudan don agree with US say dem ho stop to fight for three days and make has Sudan military still stop too.

Abdel Fattah al-Burhan nai be Sudan military oga and Mohamed Dagalo nai be RSF leader, dem two don dey fight for who get power pass since last Saturday wey don make many pipo die.

The two of dem side don try to see say dem stop the fight, dem even put three days during Eid al-Fitr to mark the holiday but small time nai dem start fight again.

But for statement wey US seketary of State, Antony Blinken bring on Monday, say the the military and the RSF don gree say dem go stop to fight for three days.

Blinken say this step go really epp to make the war stop.

While RSF for dem own side say dem go follow the deal and epp pipo wey nor be from Sudan fit komot from the kontri.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM