+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Use Result Viewing Portal, E Don Dey Work – INEC

 

The Independent National Electoral Commission don dey give anoda assurance say dem result-viewing portal wey dey hard for presidential and national assembly election, don ready to use for this Saturday election.

The Chief Press Seke to INEC Chairmo, Rotimi Oyekanmi, nai say dem go use the IReV portal as hin dey tell Punch tokpesin on Sunday.

INEC don bin hear am from political parties and different pipo since dem nor fit upload the presidential election put for the portal.

With wetin Punch news pesin check on Sunday na only 161,624 results nai INEC don upload out of the 176, 846 polling units, eight days afta the presidential election wey happen.

Even this morning dem still dey put result for the portal as all the polling unit neva still enta the portal.

Pipo dey believe say the election results go enta the portal for the election day the way INEC Chairman, Prof. Mahmood Yakubu promise but na anoda tin dem come do laslas.

Wey Oyekanmi come dey tok about the issue, hin say “The technical problem wey affect February 25 election, we don solve am. We go use the BVAS for March 11.”

He come say pipo wey dey the oda parties get right to vess but make dem karey am go.

Oyekanmi say na two parties nai dey vess about the result and dem don karey the case go for court.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM