The Nigerian Communications Commission (NCC) say abeg o, dem nor put eat down dey listen pipo call as tok don dey fly say na wetin dem set do.
Resin with dem dey come out tok be say na the audio voice wey come outside between Peter Obi and Bishop David Oyedepo wey Peter dey say Yes Daddy.
But for statement wey NCC Director of Public Affairs Reuben Muoka bring on Tuesday, say since the audio come outside nor be small messages dem dey get from media.
NCC say dem nor fit track any bodi call for anytin and make Nigeria nor listen to pipo wey dey tok tok.
The statement say the commission don dey hear so many tok and even media don dey ask dem how the audio take leak, but dem say make pipo relax as notin like say dem wan track dem call.