Just three days to wey the presidential and national assembly election go soon happen the INEC chairman Prof. Mahmood Yakubu say the raw figure of the election nor go dey online.
Na on Wednesday night for meeting nai Yakubu take tok so with the leaders of International Election Observers wey come visit am for the Commission headkwata.
He say the Presiding Officers get the right to use the Bimodal Voters Accreditation (BVAS) machine to snap election results wey dey for the results sheet from the polling unit and upload the pinsure for INEC Result Viewing Portal (IRev) for pipo wey wan look.
He say if dem put the raw figure pipo fit hack am, then Yakubu come say dem go use serious security for this election even as monie nor dey.
Yakubu come tell the visitors say the Commission don tok with financial institutions and security agencies to get dem cooperation.
He say: “E confirm say the cards wey we give voters na real one and the viter go use finger print and if e nor work e go use face, but if the two nor work nai be the pesin nor fit vote.