One Chief Magistrate Court for Markurdi Benue don talk say make dem put one 40-year-old woman Charity Upev and her son Tertsea for custody say she beat her in-law die because of meat.
The News Agency of Nigeria report say police carry Charity and her pikin go court for Criminal conspiracy and culpable homicide.
Magistrate Roseline Iyorshe no take their plea, She adjourn the mata go February 8.
The prosecution counsel, Inspector Jonah Uletu bin don tell court say for January 24, the police officer for E’ Division Police Station,Makurdi receive information say Charity and her son beat Fanen,her in-law wen dey stay with her.
The prosecutor say Charity talk say her in-law thief meat from her pot of soup.
The Police talk say Fanen con dey unconscious because of the beating wen con make dem rush am go hospital but E con die wen dem dey trat am.
According to the prosecutor, the offence break the law for section 97 and 222 of the Penal code Laws of Benue,2004.