+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Woman Wey Put Girls For Olosho Inside Delta state, Land Jail For Anambra

 

 

One 35 years woman wey be Success James don get different jail terms cus she dey karey young girls take dey do olosho work.

Na Anambra State Commissioner for Women’s Affairs and Social Welfare, Mrs Ify Obinabo nai see four girls wey be 13 and 15 years two days to Christmas for 2022 wey dey do the olosho work.

The girls come confess say na one Madam Success nai karey dem enta the business, say she go find work for dem inside restaurant for Agbor, Delta State.

Obinabo don karey security operatives go arrest Madam Success, wey dem put for Children, Sexual and Gender-Based Violence court for Awka.

The case for the woman head na child labour, child exploitation, abduction of children and child tiffing.

Chief Magistrate, Genevieve Osakwe wey give the judgement on Wednesday say Success James do all wetin dem tok for her head.

Dem come send her to Awka correctional facility for the different case ontop her head from one to four years.

The Chief Magistrate, come say all the sentence wey dem give her, all go happen same time and no fine dey to free her.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM