Workers See Woman Bodi Inside Restaurant Freezer

Pipo wey dey work for one restaurant for Louisiana wey dey US, don see one of dem fellow workers deadi bodi for inside freezer.

According to Police, na the co-workers nai see the woman bodi around 6:00 on Thursday evening.

Police dey wait to do test make dem know wetin kill her and who the pesin be.

The New Iberia Police Captain, Leland Laseter, dem neva know wetin Kpuf the woman.

Laseter tell news networks say na one of the worker nai see the woman deadi bodi inside cooler and she na worker too.

The Police Chief say even though as the death take happen dem still dey think say na accident nai happen.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM