NAFDAC say make Nigeria pipo nor fear to chop indomie wey dem do for Nigeria as that one gud to eat.
For statement wey the Director-General of NAFDAC, Prof Mrs Mojisola Adeyeye nai she take dey tok about the news wey dey fly say dem wan ban indomie.
Dem wey dey incharge say the agency dey look into the case of the tin wey two kontri for obodo abroad say dem see inside indomie.
Adeyeye say “NAFDAC don register different pipo wey dey make indomie, and we don give am stamp say e gud to eat.”
“NAFDAC nor ban indomie wey dem dey do for Nigeria o…The one wey dem do for Taiwan and Malaysia no concern pipo wey dem maks for here.”
Dem see wetin dey cause cancer ethylene oxide, for Indomie “special chicken” flavour for Taiwan and Malaysia and that tin dsm dey use am to take clean hospital tins and sometimes to kill insect.
Dufil Prima Foods Limited don even still come out through dem Group Communication Manager, Tope Ashiwaju say dem own nor be like dat.
The company say the indomie wey dem dey sell for Nigeria dey follow the local standard wey stand with international best way to take make am under ISO certificate.