Yul Edochie Don Delete All Hin Post For Instagram

Yul Edochie wey dey act film don go delete all the tins wey hin write for Instagram, just few weeks afta hin first Kambilichukwu wey May born for am.

He first delete hin profile pinsure and all the post wey he don write about he second wife Judy Austin and dem son piken.

Wey we check hin Instagram na there we come see say notin dey there again as Yul don delete every.

If you remember say na for last year 2022 April, nai Yul the piken to Pete Edochie, take announce say he don marry second wife wey all of dem dey act film, Judy Austin Muoghalu and dem don already born one boy piken.

All this one dey happen afta Kambilichukwu die for skool wey hin dey play ball.

Na for March nai the first son just do hin 16years biyday before he dey fall for ground dey die so.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM