Nigeria film actor, Yul Edochie first son wey be Kambilichukwu Edochie, don die afta hin fall for ground for skool.
Vanguard report gather say afta the boy fall down, he just dey like who nor get life, nai dem rush am for hospital.
One of dem family member say Yul don confirm say Kambilichukwu don die by the time this tori dey come out.
Tori get am say Yul Edochie wife sista wey dey where the boy dey, wey hin take read for night till morning cus of him exam wey he suppose write today.
Afta the exam, nai the boy join hin friends dey play ball na from there he take start to shake before dem come rush am go Mother and Child Hospital.
Dokitors try to make the boy nor die but hin still die.
The boy dey die only afta two months wey Yul Edochie and hin first wife May, celebrate dem first piken as he turn 16 years.