Children of 5 to10 years wey kidnapers tiff from St. Mary’s Private Catholic Primary and Secondary School for Papiri, Agwara LGA don come back on Monday.
Many of di parents just deg happy as dem children don come back even though say hunger wan finish dem life for di period wey dem stay with di kidnapers for bush.
As di children line up for govimet House for Niger, naso President Tinubu come tell security agencies say dem don try but dem get to try harder to free di remaining 115 students plus teachers wey still dey with di bandits.
Wey dem ask kwestun one Florence Michael, say wey dem dey with di kidnaper na tampolin for inside bush near river nai dem lie down put and di kidnaper say if dem make noise na korect beating go enta bodi and dem nor go return haux.
