+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

News

  • All
  • local
  • international
  • entertainment
Court Don Send Man To Prison Cus He Tear Small Girl For Osubi

Afta many months wey one man Ernest Okporu go use hin property take scatter 11 years girl for Osubi Community, court don las las decide hin case. Na for March 2024, nai Ernest go use force tear di small pikin afta he tie her with rope, dem come report to poilice from there to court bifor di case come end on Thursday. Di State High Court for Abraka,...

Make Uvwie Task Force Stop To Tiff From Pipo, Activist

Di way Uvwie Council Task Force dey take hustle pipo moni wey dem suffa work for Uvwie don dey turn anoda tin, as pipo don dey shout make di chairman do sumtin. One woman Eseoghene, case nai just bring mata out as her 300k enta some officials of Uvwie Council Task Force hand, bifor Ossai Ovie come call Israel Joe wey be activist make he go check di...

US Sojas Don Land Nigeria To Fight Terrorists

United States sojas don land Nigeria to join hand fight all di boko boys, ISIS and oda bad terrorist group wey dey disturb di kontri. Na on February 3, 2026 nai General Dagvin Anderson, wey be head of U.S. Africa Command (AFRICOM), take anounce say small of US sojas don come Nigeria afta Washington and Abuja tok about how to scatter terrorists plans. Even Nigeria Defence Minister, Christopher...

Police Arrest Girl Wey Plan To Rob Her Boyfriend For Warri

Police don arrest Jessica Anthony, one girl wey go plan with arm robbas make dem go tif 7million from di boyfriend make she use am take pay her sista hospital bill. Jessica na just 24 years wey waka go meet some bad boys for Warri come dey tell dem her plan say she want make dem go tiff from di boyfriend, but one of di bad boys know...

Police Arrest Papa Wey Nack 9yrs Pikin For Hotel Inside Issele-Uku

Dem say papa don go chop hin own girl pikin wey be just 9 years for hotel, as he karey di pikin as babe go rent hotel for inside Issele-Uku, Aniocha North. Tori from Delta State police command afta hand don touch di man say na hin first go report case for station say hotel wey he rent, na there dem take nack hin pikin. According to di...

Wife Don Finish Husband, Side Chick With Cutlass For Ughelli

One woman wey dem nor call her name don kill her husband and side babe for Ughelli afta she don dey shout about how di man nor dey use eye see any color of skirt. Di woman wey be from Isoko, na mama of two children but police now don arrest her cus she use cutlass take finish di husband skull for dem haux wey dey for Ighwre-Ovie...

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM