+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

20k Don Make Policeman Cut Wife Hand For Plateau

One man for Dong side inside Jos North LGA, Plateau State don put e name for world record as di man wey cut hin pregnant wife hand cus of 3k.

Di officer wey leave 20k for hass but as he come back come kolet di moni nai he notice say 3k don short from di moni.

Naso he come dey argue with di wife say make she return di moni di woman say she nor dey return. Dem come dey drag bifor you know, husband don karey cutlass fling wife hand.

Neighbors say dem shock to see wetin di husband do, naso dem rush di pregnant woman go hospital.

Tokpesin of Plateau State, DSP Alfred Alabo, don confam wetin hapun. He say dem don transfer di man go State CID for investigation to di mata.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM