Pipo wey like Annie Macaulay Idibia, di foma wife of Singer, Innocent Idibia aka 2Baba don dey greet her say na new start for her as she don delete all messages for her Instagram.
Annie don dey quiet since her husband, 2Baba say he nor do again and come dey follow Natasha Osawaru wey be lawmaker for Edo State.
But on Thursday nai Annie come Instagram delete all her post, and all of this dey hapun days afta pipo see 2Baba with Natasha dey do shopping for one boutique for Benin.
As Annie don delete tins for her page, nor tok anytin or even write sumtin sef, many pipo dey find explanation to wetin dey her mind.