+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

419 Dey Use My Face For Fake Employment – Delta SSG

Seketary to Delta State Govimet don dey call pipo wey dey stay for di state to know di kind text message and WhatsApp wey dem dey get about employment from govimet.

Dr Kingsley Emu say some yahoo yahoo boys don dey use di office of the Seketary of Delta State Govimet take dey lie say dem go give work to pipo if dem pay small moni.

Di SSG say that one na big lie cus any appointment like that go come from di State Govimet and nor bodi go even ask for moni for di contact thru text message or WhatsApp.

Dr Emu come give di nuba of di 419 as 08085129491 dem go some tell dem maga to send moni to one Mr Jonah Kumor Zenith Bank Account Number: 4235384296. Nai he beg pipo to verify any information wey dem get bifor dem start to jump for joy.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM