+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Agbarho Man Kill Him 6yrs Dauta For Moni Rituals

One Stanley Ovemureye wey dey stay for Uvwiama, New layout for Agbarho inside Ughelli North LGA, don kill he 6years pikin, Abigail Ovemureye for moni ritual.

Right now police for Delta State don dey find Stanley cus he run afta he kill di pikin finish on 15 June 2024.

According to DSP Bright Edafe, PPRO, na Stanley junior broda nai come report di case give dem.

Police don kolet di deadi bodi of small Abigail, put am for mortuary dem even see as di papa finish di girl head for wall.

Even di State Commissioner, CP Abaniwonda Olufemi don dey tell anybodi wey get info about Stanley to report am to any police wey dey close.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM