+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Save Nigeria From Gbese– Foma President Obasanjo

Di foma President of Nigeria, Olusegun Obasanjo for one Safe Online Youth Fellowship Bootcamp wey dem do for Abeokuta, with NYSC members from Lagos and Ogun State, nai dey tell di corpers make dem put eye for how to bring national development tp di kontri.

Na NerdzFactory Company nai organize do event then Meta Youth Development Centre, Olusegun Obasanjo Presidential Library (OOPL) come support, nai di foma President say he administration nai be one of di best wey Nigeria don get since 1999-2007 cus he leavs di economy for beta position.

As Obasanjo dey still celebrate 25 years of democracy for di kontri, he come still say na he administration nai save Nigeria for heavy gbese wey dey press neck ans even bifor he komot from office he leave enough moni for ground.

As Obasanjo dey advice di youths make dem nor losse guard, he say as dem dey go their different place to serve make dem create impact wey go dey different and pipo nor go forget am.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM