+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bad Road Wan Don Finish Us–Onicha-Ugbo Community Cry

Di pipo wey dey stay for Onicha-Ugbo community inside Aniocha North LGA don dey beg Govinor Sherrif Oborewori make he come attend to di bad road wey don nearly cut dem from main town.

Dem still say make di Chairman of Niger Delta Development Corporation, NDDC, Chiedu Ebie still come to epp as di major road from di Local Govimet Headkwata from Issele-Uku to di village na no go area.

For two years nai di road don dey like that bifor e come finally kpafuka and di Local Council authorities nor even fit do anytin, so make di state govimet come to their rescue.

Where worst pass na opposite Gbonoza Primary Skool for Onicha-Ugbo cus for motor, Okada and other big trucks to pass na die.

One pesin wey dey stay for di community, Ohia Emmanuel Chukwunweike say were be di baddest na between Onicha Ugbo and Issele Uku and tight now e dey hard village pipo to go dem farm or even Issele uku market.

Emma come dey follow beg NDDC, state govimet and all stakeholders make dem quickly come attend to di road so that pipo for enjoy di benefit of democracy.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM