+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Prank Don Make Graduate For Unizik Jump Komot From Keke Die

Pipo don dey urge Nnamdi Azikiwe University wey dey for Awka, Anambra State to look into di death of a young graduate Ifunanya Miracle aka Bliss and her friend afta pesin play prank on dem.

Miracle just finish from di Department of Quantity Surveying, bifor she come start to dey do PoS business inside di skool.

Story change on June 9 afta she finish business for evening pack her tins join with her friend, Peace wey dey for Pure and Industrial Chemistry department come enta keke to go hass.

Na for inside di keke nai one guy try to kolet dem phone, bifor you know Miracle don jump come outside from di keke use her head take nack ground while Peace wey folow jump get serious wound full bodi, dem come rush her to Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University Teaching Hospital were she still dey take treatment.

Tokpesin of Unizik, Dr Emmanuel Ojukwu, confam say na one final year student nai go do di girls prank for inside keke wey dey move.

Dem don do meeting with di prankster, Miracle family and di university, afta di burial of Miracle di skool go deal with Mr pranker.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM