+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fear As Another Building Fall For Anambra State

Di way building just take dey fall for Anambra State nowadays just dey make pipo dey wonder why di state govimet never di samakwe punishment for owners head according to wetin di law for di state tok

On Thursday nai anoda two-storey building wey dey for Eke Amawbia Market inside Awka fall again and many pipo get wound, still dey wonder di nuba of pipo wey die.

Pipo wey dey sell for di market say di tins wey dem take dey construct di building nor be beta one and cheapaticle just dey show for di whole work.

Bifor now, some other buildings for di state just dey fall anyhow, even di one wey govimet bin dey build for Ochanja market fall and bad news be say pipo die ontop.

Pipo wey get mind don dey call Govinor Charles Soludo make he do sumtin cus if na private pesin nai get di property di case for don be sorry.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM