+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

More CNG Stations Bifor Anoda One Year Finish, FG Promise Nigeria

Since President Bola Tinubu don bin promise Compressed Natural Gas motors to epp cus of di fuel subsidy wey govimet komot, Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL, say bifor anoda one year go finish dem go get more CNG gas stations for di different states.

Na di Managing Director of NNPCL Retail, Huub Stokman nai announce say na 100 CNG stations dem wan add to di 11 wey dem just open for Lagos and Abuja.

According to Stokman wey dey tok on Thursday, he say CNG dey very cheap and pipo go fit buy am wella especially for those wey nor fit pay for fuel.

Nai he come say make Nigeria pipo kulele cus bifor anoda one year go reach CNG site go don full every kona plus with investment dem sure say every tin go dey okay.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM