+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Tinubu Send Messengers To Go Beg Mali, Niger and Burkina Faso

Economic Community of West African States (ECOWAS), don restamp President Bola Tinubu as di chairman of di regional bloc afta he don bin finish one year term.

Na for di 63rd Ordinary Session of di Authority, Heads of States govimet of ECOWAS wey dem do on Sunday for Presidential villa for Abuja nai all of dem take gree for Tinubu to go again.

During di one year wey Tinubu dey as chairman wahala just bust as Niger Republic, Mali, Burkina Faso and Guinea just over throw civilian govimet change to military.

As di bloc don say make Tinubu stay for anoda one year, nai he appoint Senegal President, Bassirou Faye and Togo President, Faure Gnassingbé, make dem go spin Mali, Burkina Faso and Niger Republic so that dem fit come back to ECOWAS.

Know say military junta leaders for Niger, Mali, and Burkina Faso don dey shout since say dem nor dey come back to ECOWAS again even afta di sanctions don komot.

Dem dey vex say ECOWAS nor get mind of dem own, dem dey hear from wetin foreign power dey tell dem to do first and cus of that do teree nations say dem go form dem own alliance.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM