+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Di Blog Wey Say I Be Akpabio Babe, I Dey Come Afta You — Actress Dakore

Wahala dey for social media last week afta pipo see di video wey Senate President, Godswill Akpabio take dey curse one woman lawmaker wey ask Govimet to build market wey burn for Abuja but Akpabio say dem nor fit use govimet moni take do thay kind tin.

Na di word nai one Instagram blog come karey use am take dey drag di Senate Presido for ground say if he nor beg he go bring out information about am and he kurukere waka.

Bifor eye close open nai Akpabio phone nuba, him wife and that if he two babes drop for social media.

According to di aproko one of di side chick na big pesin wey dey sell hair and other tins while di second one come be Nollywood actress, Dakore Egbuson-Akande.

But right now di actress don come out sag she never even seen Akpabio once not to tok of say dem don sitdon tok.

Naso Dakore start to vex provoke for inside Instagram, say any pesin wey don get video, pinsure or voice note of where she and Senate Presido take dey kerewawa or waka togeda make dem bring am out and she go pay di pesin N5m.

Di actress say na big lie from hell fire nai dem just cook to spoil her name, character and family wey she don build for years cus pipo just dey wan use calls and text messages take finish her.

She say di wicked blog just wan spoil her life but dis time if e dey do with other pipo go free, e just jam rock.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM