+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pipo Don Dey Greet Di Family Of Ohanaeze Ndigbo Presido Wey Die

Many tears dey run for Igbo pipo eyes afta dem hear say dem leader, President General of Ohanaeze Ndigbo, Chief Emmanuel Iwuanyanwu don die.

Dem political leaders don dey send greetings and sorry messages to di President General of Ohanaeze Ndigbo worldwide and President of Owerri Peoples Assembly family afta di son announced on Thursday say he 82 years papa don die just afta small sickness.

As Senator Victor Umeh wey dey rep Anambra Central Senatorial District dey join others cry for Iwuanyanwu death, he say e bad say all di beta men wey dem dey get for Igbo land jusy dey die.

Na for one event for Ngodo, Nise on Thursday afta dem just announce di man death.

Di family say dem go soon announce di date wey dem go bury di late presido.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM