+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

#Hunger Strike Day1: Four Pipo don touch bullet For Suleja

As di hunger end bad govimet strike start today for different part of di kontri, na four pesin nai dem say gun don touch while plenty wound for Suleja, Niger State.

Pipo wey dey protest bin go block Abuja-Kaduna express road wey come make serious hold up dey di road, police come dey try to drive pipo back nai dem start to shoot.

One of all those many gun shoot come touch one man, Yahaya Nda Isah wey dey stay for Hassan Dalatu Road, Suleja, and he nor fit survive am.

Dem say Isah nor even join di protest, he just dey ride he bike pass front of Suleja Police ‘A’ Division bifor di bullet just touch am straight for chest na there he die.

Tokpesin of Niger State Command, SP Wasiu Abiodun, say really police get to drive di protest pipo back cus jaguda boys don dey almost one burn Tafa Local Govimet Area office.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM