+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Borno Govimet Put Curfew As Hunger Protest Turn Anoda Tin

Dem don put 24-hour curfew for teree states for North only yesterday wey di protest just start cus nor be small tiffing and destroying of property hapun as jaguda boys just put bodi to scatter tins.

For Borno, Kano, and Yobe states, di tin be somehow cus security tok say Boko Haram nai kill four pesin for Baga Road, Maiduguri and 34 pipo nai wound.

So that too much bad nor go hapun di state Govinor, Babagana Zulum come reduce time of waka cus many small children enta street plus alamajiris, dey tiff and scatter tins even enta di Borno State Traffic Maintenance Agency go loot di place.

Wey tokpesin dey tok about di curfew Speaking about the curfew, the spokesperson of Borno Command, ASP Nahum Dado dey tok about di curfew he say di state don suffa reach so e nor go make sense say dem add to am, e beta make everybodi rest.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM