+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

You Say 3months NPA Go Work, One Year Don Pass — Bishop Attack Presido Tinubu

Di General Overseer of Praise God Revival Ministry for Enerhen, Bishop Ajokpaoghene Okijenu, don karey he own protest to front of Nigeria Ports Authority, NPA Warri, say make Presido come start work for di seaport.

Di Bishop waka with some of he members as dem karey display paper say dem nor happy with Tinubu cus he promise say afta teree months wey he dey for office NPA go come back to live.

Okijenu say na fawol play nai dem dey cus dis na one year afta di govimet but notin don hapun for di port and even di refinery for di state dey one side. Nai he give FG six months to come work di port of face disco.

Di Bishop say if dem dig di seaport e go epp as work go even dey and state plus federal go benefit from di revenue.

He nor troway hunger as one of di main time wey dey cus di protest so e go make sense if FG do di needful to save matas.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM