+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

#EndbadGovernance: Leader Of Protest For Abuja, DSS Arrest Am Early Mormor

National Coordinator of Youth Rights Campaign, Micheal Lenin, wey join organizers for Abuja #EndbadGovernance protest, DSS don arrest Al for he house for Apo, Abuja.

Wetin Damare Adenola, Director of the Take it Back Movement, tell tori pipo be say na around 2 early mormor on Monday nai DSS go Lenin house, beat am for he family present and karey am away.

Di mata start afta di address wey Presido Tinubu give on Sunday wey dey make many pipo para as he nor tok anytin about di protest.

Lenin come out for press conference dey tok he mind that same Sunday afternoon say make pipo come out on Monday for di protest as govimet don fail for dem gragra to make pipo fear.

Right now tori pipo don call DSS tokpesin Peter Afunanya nuba tire he nor dey pick and even message he never ansa.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM