+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ali Ndume Fit Return As Chief Whip – APC

APC dem leader and national working committee don call Senator Ali Ndume wey dem porchu as Chief whip of di house cause he dey tok against Presido Bola Tinubu, to hear he own side.

Di party bin komot Ndume replace am work Senator Tahir Monguno afta di NWC go complain give Senate Presido.

Wey di committee finish dem meeting as di National Chairman, Abdullahi Ganduje come dey give brief, nai he say Ndume beg dem and all of dem don agree cus na family mata, so dem get solve am as family.

Then Ndume come say he gree, next time he nor go karey come out to tok about mata wey dem never settle for di party outside.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM