+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dem Do Me Well For India, Rema Ansa $3m Pay For India Wedding

Afrobeat beat singer Rema wey sing for Anant Ambani and Radhika Merchant wedding for July 12 for India, don open up about di rumour wey dey waka say na million of dollars dem pay am.

Na for Jio World Centre for Bandra Kurla Centre (BKC) Mumbai nai dem take do di wedding between Asia richest man, Mukesh Ambani, and pharmacy tycoons Viren and Shaila Merchant.

Hindustan Times come report di tori say na heavy 3 million dollars nai dem pay Rema for he performance

Laslas for interview nai di ‘Baby Calm Down singer don tok how much dem pay am wey dem ask am reach there.

“Hehehe. Na di only tin wey I fit tok. But make I tok true. Money side dey and all di sides. Infact do treatment wey dem give me for India na die,” wetin Rema tok.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM